Ghana Chef Ebenezer Smith cooking marathon na fake - GWR

Millenium chef smith

Wia dis foto come from, MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

  • Author, Komla Adom
  • Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
  • Reporting from Accra

Guinness world record say Ghana chef Smith no be di longest cookathon record holder

Dis na GWR response to plenti queries about di press conference wey one Ghana chef Ebenezer Smith don do for Accra wia im tok say im break di cookathon record.

Ebenezer Smith (aka Millennium Chef Smith) for dat press conference wey dem beam live for di state broadcaster and oda media platforms, tok say im receive di certificate afta more than twelve weeks of im attempt.

On top wetin im present for di press conference, dem write for top say, “di longest cooking marathon (individual) is 802 hours 25 minutes and im bin achieved by Ebenezer Smith (Ghana) for Spintex, Accra - Ghana, from 1 February to 6 March 2024.”

But one query wia di BBC News pidgin service don send to Guinness world record, dem tok say Chef Smith neva break di current record.

Alina Polianskaya, PR Executive for Guinness world record write say “im neva be true. Im neva bin hold di record wia dat neva be our certificate.”

Im also add say “di current and true record holder “The longest cooking marathon (individual) is 119 hr 57 min 16 sec and was achieved by Alan Fisher (Ireland) in Matsue, Shimane, Japan, from 28 September to 3 October 2023

Chef Ebenezer Smith fake claim

Ebenezer Smith alias Millenium Chef Smith) bin claim say im be di latest Guinness world record holder for di longest cooking marathon.

Chef Smith tell tori pipo for Ghana say im get di record afta im cook for 802 hours 25 minutes.

Millenium Chef smith also say beat di record wey one Irish chef Alan Fisher bin dey hold wey be 119 hours 57 minutes.

Afta nine days of baking and cooking, Alan make 357 kg worth of soda bread and 590kg worth of dishes (3,360 portions wit 32 recipes).

At di time, Hilda Baci tweet to congratulate Alan Fisher afta im break her record.

“Huge congratulations to Alan Fisher. 119 hours and 57 mins na huge achievement. I wish am all di best as di new record holder,” Hilda write for Twitter formerly know as X.

Di certificate and Chef Smith

Wia dis foto come from, MX24/MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

Dis na di second time Chef Smith dey apply to attempt di longest cooking marathon.

Di first time im apply na for June 2023 but im no get di approval from Guinness, wey im apply again for November of di same year.

But e claim say im get approval inside January 2024 wey im and di team begin to plan di cookathon.

Afta di press conference some pipo begin to raise questions about di record wey chef Smith tok say im get.

Pipo begin dey point say di certificate wey im carry show di press for di live press conference na fake.

But chef Smith im manager, oga Benny tok say di tins pipo dey tok neva be true.

“Dis certificate be from Guinness world records, e neva be fake, anybody wey gatz doubts fit verify wit di guinness pipo,” im tok for one radio station (Hitz fm).

Im add say “for dis our regular assessment wey dey take up to 12 weeks, di Guinness pipo send we email say Chef Smith gat di record, so if pipo no dey believe, make dem do dia checks.”

For social media pipo don dey bash di chef and im management to come out and clear all di doubts, some pipo already begin dey call am fraud.

Chef Smith and im assistant

Wia dis foto come from, MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

In di last seven months, plenti pipo don attempt to break one guinness world record or another for Ghana.

Media personality and enterpreneur Afua Asantewaa Aduonum attempt longest singing marathon for December 2023, but despite say im sing for 126 hours and 52 minutes during di Christmas festivities, afta three months, Guinness pipo write to am say im attempt dey unsuccessful sake of issues for di rest breaks.

Chef Faila also attempt di longest cooking marathon for Tamale for January wia she also cook for 227 hours.

But im attempt also fail as Guinness tok say dem breach di rules for rest breaks.

Only last month, one-year-old pickin get di record as di youngest male artist for di world afta Guinness confam im attempt.

Ace Liam bin attempt di record di time im dey one year four months, wey im do ova 20 paintings for one exhibition. Im also sell all di paintings wey be one of di requirement for di record.

One oda pesin Adu Sarfowaa attempt di longest speech marathon for 130 hours in February.

Im neva tok di public whether di attempt dey successful or im fail.

Police arrest Chef Smith

Afta di press conference, police don arrest chef smith and im manager sake of di main sponsor of di cookathon Amadia shopping center, tok say chef smith and im team no stick to dia agreement for di beginning.

Di company wey offer dia space and equipment for di month-long cookathon don vex.

One of di pipo for di company don storm di venue for di press conference to understand why di chef neva inform dem about dis email wey im go anoda venue go do di public announcement.

Lawyer for Chef Smith Kofi Awoonor tok on Tuesday night for local TV station (TV3) say say di arrest na “in connection wit some disagreement wit chef smith im lead sponsor for di cookathon.”

“I bin get call say police don arrest my client na so I come hia but di officers tok say di commander no dey around wia investigators also no dey di office at di time - but dem go brief me on Wednesday about di full details.”

According to one of di former team members of di chef wey support wit publicity during di cookathon, di owners of di shopping center try to meet wit di chef bifor di press conference but im and di manager no allow dat meeting.

Naa Adjeley tok say “di company, don pump ova Gh ¢ 300k for di cookathon - for equipment, foodstuff and tins wia dem use for di attempt, na so dem vex say di chef no tok dem anything bifor im go do di press conference.”

Im also add say di chef don get new manager and team wia don dey run tins - so dem sideline all di pipo wey dey inside di team during di cookathon attempt.

“Bifor i lerf di police station Tuesday night, na di chef and im manager dey dia dey answer questions.

As di company Amadia shopping center don dey drag di chef ova wetin dey describe as breach of dia agreement, odas don write to Guinness world records to confam if indeed Chef Smith be di official record holder.

We don update dis tori wit di latest informate from Guinness World Record (GWR)